Kenya president-elect and opponent go meet US senator

Kenya President-elect William Ruto and im main rival for di recent election Raila Odinga go meet wit US Senator Chris Coon wey dey on a five-kontri Africa visit.

US neva yet congratulate Ruto afta di official declaration wey say im win last week election.

Odinga bin tok say e no recognise di result.

Senator Coon and im delegation go also meet with President Uhuru Kenyatta.

Di senator arrive for di capital, Nairobi, on Wednesday night and go hold tok with di three leaders on “health, security, and economic prosperity”, di US embassy tok.

Di delegation go also meet conservationists, health providers and organisations working to empower girls.

By ethionegari@gmail.com

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *