‘Some pipo no want me for Manchester United…I feel betrayed’ – Cristiano Ronaldo

Cristiano Ronaldo say im feel “betrayed” by Manchester United and dem don force am out of di club.

For August, Ronaldo promise say im go give im version of life for Old Trafford afta im no get any Champions League club wey ready to cari am comot from United as im bin dey expect.

Ronaldo don finally break im silence as im tok im mind, im open im belle inside one interview interview wit Piers Morgan for TalkTV.

Dem don ask Manchester United to respond to di tins wey Ronaldo tok.

Manchester United  wey beat Fulham 2-1 on Sunday, na fifth for di Premier League .

And na Oga Ten Hag first season in charge of di club.

Wen dem ask Ronaldo if di big-big oga dem for Manchester United hierarchy dey try to force am to comot from di club, Ronaldo answer: “Yes, no be only di coach [Erik ten Hag], but anoda two or three guys wey dey around di club. I dey feel “betrayed.”

Dem ask am again if senior club executives dey try to remove am, di 37-year-old say: “I no care. Make pipo listen to di truth.

“Yes, I feel betrayed and I feel like some pipo no want me for hia, no be only dis year but last year too.”

By ethionegari@gmail.com

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *