Rwanda music star Yvan Buravan don die for age of 27

van Buravan, one Rwandan R&B star don die of pancreatic cancer for di age of 27.

Im manager confirm di news of Buravan death give di

Dem bin dey treat Yvan Burabyo [im real name] wey dey well known as Buravan for India.

E bin don receive treatment for Rwanda and Kenya, before dem transfer am go India. 

Dem discover Yvan Burabyo talent wen e become second for one national music competition for di age of 14.

Im hit song ‘Malaika’, wey e release for 2016 make am enta stardom for Rwanda.

For 2018 e win one of di biggest African music contest ‘Prix Découvertes’ organise by RFI and UNESCO.

 Many Rwandans on social media dey mourn im death.

By ethionegari@gmail.com

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *